Загрузка...

NO do pass yourself for this life | Pidgin English Motivation

The dream no be to turn up today, then melo tomorrow, the dream na to turn up everyday. So no do pass yourself when your hand never strong reach. No carry load wey you no fit carry, especially if the load no go help you in any good way. No dey allow wetin u dey see online or hear dey move you reach wey you go wan put yourself inside wahala, all because you wan belong. Whether na for money matter, relationship o, house o, anything e be, "If it didn't dey, it didn't dey", no go dey one follow people wey firm pass you show off or carry leg enter place wey you know say no good for you.

Even some of the people wey dey show off, fit be audio doings las las; maybe no be dem really dey run the spendings and maybe the relationship dem dey advertise fit no even sweet reach how you see am, but you wey no know go don dey gather debt just to follow up or enter relationship with person wey dey make your life miserable so that people go say you belong.

No enjoyment without peace of mind. Real enjoyment dey carry peace follow body, so If something no dey give you peace of mind, nothing sweet there. Understand this one before you dey say you dey ball steady or dey enjoy life.

No do pass yourself. GOD wey create you, still get time wey that thing wey dey enter your eyes go come meet you, and when e come, e go carry peace join body. NOTHING SWEET PASS GOD OWN, So relax. You fit dey view things to ginger yourself, but no enter when you know say e go cause you wahala later. The dream no be to get am today, then melo tomorrow, na to get am EVERYDAY. GOD DEY. BELIEVE BABA GOD AND BELIEVE YOURSELF.

#GOD #grazef6 #motivation #inspiration #pidgin #pidginenglish #reels #nigeria

Видео NO do pass yourself for this life | Pidgin English Motivation канала Grazef6 Pidgin
Страницу в закладки Мои закладки
Все заметки Новая заметка Страницу в заметки